Abeg no laugh o...
Android don chop my money tire, na him I come vex
yestaday sell am, come take some money buy China phone!
Now am in bigger trouble!!!
1. E go full after 3 minutes of charging.
2. The phone get TV, Touch screen, Nail cutter, Firelighter etc.
3. I fit write Text message with a toothpick sef.
4. The spelling get mistakes e.g NokLa, blackderry, i-porn, samswag etc.
5. When aeroplane pass e go record "One missed Call".
6. When a big trailer horn; e go show "Charger connected"
7. When Chinese man pass e go show: "One Bluetooth device found"
8. When fine person waka pass, e go show "Ur food has been found"
9. When ugly person waka pass, e go show, "Virus detected"
Abeg I wan sell am!
Who wan buy ooo?
Even as I dey find buyer, e dey show me for screen: "No contact found..... "
No comments:
Post a Comment